8 reasons why some women no dey climax
25 February 2024New Informate 7 hours wey don pass
(O)(A)
Dis tori contain some sexual yarns wey only adults suppose read.
For many pipo, wey include scientists and doctors wey specialise in sexology, di female orgasm na somtin wey dem neva discover finish.
Dem don write plenti tins about dis sensation of intense pleasure in women.
However, no be all women fit experience am. Some even confess say dem neva feel am for once.
Na many factors dey influence orgasm, from psychological, emotional to physical and hormonal.
BBC explore eight factors wey fit make women fail to climax.
Negative experiences from di past
Traumatic experiences fit block victims from sexual encounters wit dia partners.If di woman don experience traumatic situation in di past wey no make her sexual relations smooth, e dey advisable say she share di experience wit her partner or lover, so dat e go fit understand and support her.
But if she no fit share di situation, e dey important for her to seek special help so dat she go fit deal wit di trauma. E dey important to tok about am to a counsellor for her to get professional help.
"For dis kain situation, di woman get work she gatz do. E dey important becos di situation she live through fit cause her plenty shame or fear and, for some circles, e fit make pipo dey reject her," Héctor Galván, one clinical director of di Madrid Institute of Psychology and Sexology explain for inside one statement e give BBC.
Seeking psychological assistance fit help you face painful situations wey relate to sexuality.
E dey important for her to decide wen and how much information she wan share wit anoda pesin.
"Wen a woman reach dis point of blockage and she dey embarrassed to explain wetin happun, e dey preferable she tell her partner say e dey difficult for her to to tok about dis tin and go like work on di sexual issue individually witout going into details. Afterwards, wit di therapist, di problem fit dey worked on confidentially.
"Di ideal tin go be make she fit discuss am openly wit di partner, but e beta if pesin prefer to reserve a small part of im or her intimate world, but still manage to improve im or her sex life wit partner, pass if dem no even try to," di sexologist explain.
To dey in a hurry and dey stressed
Finding balance between work and personal life na one of di challenges for women for many cities around di world.Although for her practice, Galván don meet women wey find am difficult to reach orgasm sake of modesty or feelings of guilt wey get root inside veri conservative upbringing, she point out say dose tins make up di smallest number of cases.
One of di main factors she don observe for patients she don treat na di stress dem go through before dem arrive at di sexual encounter.
"For di woman to easily reach orgasm, fairly high degree of relaxation dey important," di doctor tok.
"Di organism fit reach desire and arousal (wey be di two first phases of orgasm) but we no need to dey relaxed for di final phase of orgasm.
Stress fit come from di schedules of many people, wit demanding jobs, schedules to meetings, working hours away from home, in some cases children dey to care for.
Although for dis situations, some women fit dey tempted to fake orgasm not only becos dem no want di sexual encounter to take too long, but also becos dem no wan hurt di ego of dia sexual partner, di clinical psychologist recommend make dem no do like dat.
E dey advisable to tok and raise di situation as somtin to improve.
Keeping quiet
Experts recommend make women follow dia partners tok on di kain stimulation dem like and wetin dem fit do to improve dia sexual encounters.E dey necessary to understand say for inside sexual relationship, no one fit guess correctly how di oda pesin dey feel.
Pesin fit read gestures and sounds, but di koko na to tok – give feedback.
"Many pipo during intercourse dey find am difficult to direct dia partner, to ask for certain changes, certain adjustments, in sexual practice," di sexologist tok.
"In consultation, we fit see woman wey explain give us say wen she dey about to reach orgasm, na dat time her partner dey change di rhythm or withdraw from penetration, but she neva eva tell.
Sake of dat, di specialist dey of di position say e dey important to normalise communication not only before and afta di sexual encounter, but also during.
"Dem gatz dey aware say dia partner no fit guess di physical sensations dem dey get and wetin dem need to reach orgasm."
Another factor wey Galván and im team of experts don encounter wen dem dey treat some heterosexual patients na: premature ejaculation.
"Na di best profile wey fit reach us," di clinical psychologist tok.
"Sometimes di woman dey come alone becos she dey afraid of hurting her partner pride and she tell us, in private, say di couple dey usually last veri little and she no get time to reach organism. Dat na good news becos working premature ejaculation dey quite simple technically. Di solution dey simpler dan if oda problems dey."
Poor and ineffective stimulation
According to Galván, in recent years e don see improvement in heterosexual couples wen e come to dedicating time to stimulation before penetration."Decades ago, e dey more common for roles to dey more asymmetrical, wey mean say na man go dey seek im pleasure quickly, but dat don dey change."
Directing your partner during sexual intercourse fit help both parties understand and please each oda beta.
Di problem no be say dem dey give more or less time to di preparatory phase, but rather dat of communication.
Among lesbian couples, dem dey give room for more sexual dialogue, but di situation dey different in some heterosexual relationships, experts tok.
Di key na for di woman to explain to her partner (man or woman) wetin to do, how to do am, at what rhythm and for which part of her bodi.
"Sometimes women dey tell us say di man no sabi how to stimulate di clitoris or dem go say sometimes e dey pain dem and wen you ask dem if dem don discuss am wit dia partner, dem say dem dey fear make dem no go hurt di feelings of dia partners or becos dem dey embarrassed."
And for dis process of stimulation, masturbation fit also dey important for many women, no be only before intercourse as a way to enta di phase of arousal and wetting of di vagina (an important aspect to avoid discomfort during penetration) but also afterwards.
Lack of sexual desire
Many women feel say motherhood dey affect dia sexual desire.Di UK National Health Service (NHS) explain say lack of sexual desire fit affect women for different stages of dia lives.
or example, during pregnancy, afta dem born, for stressful situations and for menopause.
Depression, psychological trauma, di use of some kain medications plus hormonal disorders fit get impact on having sexual relationship and, therefore, on experiencing orgasm.
Di NHS show say sexual desire fit decrease if woman natural testosterone levels drop.
Testosterone dey produced for di ovaries and adrenal glands and if dis organs no dey function well, di woman go experience some consequences, including for her sexuality.
Dat na why e dey important to undergo regular medical check-ups if endocrinological problems dey.
If di problem relate to insufficient hormones like testosterone or oestrogen, di doctor fit recommend hormone replacement therapy.
Self-demanding
Taking time for di sexual encounter na key.Di sexologist wey BBC consult tok say wen im centre analyse di profile of some of di patients, dem find personality traits wey be like say e dey a bit controlling, obsessive and perfectionist.
"Wen on certain one occasion, pesin wey normally dey reach orgasm no achieve am - and present a self-demanding profile - from den on, in view of di following relations, she start to dey observe herself, to check if she fit reach orgasm and dat attitude go make am impossible to achieve am becos she don create tension wey focus on her own performance".
For dis kain situation, relaxation and enjoyment once again na di key.
To dey get pain during sexual intercourse
Report any pain and infection to di doctor for immediate treatment.Anoda sickness, Galván tok na dyspareunia, wey dey cause women to feel deep pain, burning and discomfort during intercourse, even before and afta intercourse.
For her opinion, e dey common pass vaginismus.
Psychological problem or infection fit cause Dyspareunia and e dey important to treat am becos "wen di brain link sexuality wit pain, e go get repercussions on sexual desire and, therefore, sexual relations go dey avoided".
Wen woman get vaginal infection and dryness for dat area, e dey important she see doctor for proper treatment becos di consequences fit pass di sexual level.
"Pain during sex dey common afta menopause, as estrogen levels dey decrease and di vagina dey feel dry," di NHS tok.
"Dat fit affect woman sex drive, but lubricating creams dey to help," dem add.
Hidden relationship problems
For di gynaecological field, factors dey wey dey affect woman ability to reach orgasmOne of di last problems di specialist tok about relate to di veri basis of di relationship.
"Sometimes couple go come to us wit sexual problem like anorgasmia (absence of orgasm) in di woman, di evaluation we make show say problems dey for di relationship," di doctor explain.
If dis na di case, di recommendation na to try to focus on solving dose problems wey no only dey affect di sexual life, but also oda areas of life as couple.