- Joined
- Jun 30, 2023
Some quality international coverage of Trudy's kinda-sorta resignation:


Negro News Network said:Justin Trudeau resign as Canada prime minister
Canadian Prime Minister Justin Trudeau don resign im position on Monday 6 January.
Trudeau announce im resignation for one press conference.
E reveal say im bin make im decision to resign afta long tok-tok wit im family and say na just last night im tell im pikin say e go resign.
Di former prime minister go also step down as Liberal leader.
Many Liberal members of parliament wey don dey worry about di different negative results for polls bin tell Trudeau for public say make im resign.
Calls to resign grow
Trudeau become Liberal leader for 2013 wen di party bin dey inside big gbege wey land am for number three position for di House of Commons for di first time.
As im don resign, e go lead to fresh calls for quick election to maintain stable goment wey go fit deal wit di president-elect Donald Trump goment for di next four years.
Trudeau bin ansa questions from press say becos of "internal gbas-gbos", e no fit be di leader of di Liberals enta di next elections.
Tori be say di prime minister don discuss wit Finance Minister Dominic LeBlanc weda im go wan become interim leader and prime minister. But di newspaper say dis plan no go work if LeBlanc wan run for di leadership position.
Trudeau, 53, bin manage silence Liberal MPs worry about bad polls and di safe seats wey dem lose for two special elections.
But calls for am to step aside don grow since December wen im bin try to demote Finance Minister Chrystia Freeland, one of im closest cabinet allies, afta she push back against im proposals for more spending.
Freeland resign instead, kon write letter wey accuse Trudeau of "political gimmicks" instead of to focus on wetin dey best for di kontri.
Trudeau say e bin really hope say im long term ally Freeland go continue as finance minister and deputy prime minister but "she choose anoda way".
But e no gree tok wetin happun wey cause Freeland to resign weeks ago.
"I no be pesin wey like to dey tok private mata come outside," e tok.
Trudeau lead Liberals to power for 2015 wit promise of "sunny ways" and progressive agenda wey go promote right of women plus fight climate change.
But dis no come be di case sake of many different reasons like di Covid pandemic, high cost of living plus immigration policy wey lead to hundreds of thousands of arrivals.
Bifor Trudeau end im press conference, e tok say im hope na say di temperature for Canadian politics go come down so dat dem go fit focus on wetin dey important
Wetin go happun next?
So wetin go be di next tin wey go happun afta di Trudeau announcement wey im just drop so?
Justin Trudeau don reveal say di reset wey im dey find for di Canadian politics go happun in two parts.
Dem be di prorogation of di parliament till late March and Trudeau resignation wey im believe say go "reduce di level of polarisation for politics".
Di prorogation of di parliament mean say all proceedings, debates and votes for di house dey suspended till March.